28/03/2024
```*Good morning everyone!
Abuja agents be like 🙄🙄🙄😜
And the applicants go see us like scammers 🥸🥸😤😤
Our clients go dey think say we be like 👑👑👑
Agents policy go be like 🙄 🙄 na devil 👿 create am 😭😭
Registration fee go be like say you dey pay for agent fee , 😁😁Chai.
This life no balance at all.
Agent fee go be like say na the employee go still dey pay agent monthly, Chai 😂 😂
Which kind generation we dey like this 😀 😀
After registration fee, you wey dem invite you for interview, when dem don accept you, you go come dey think on how you go get transport fee from home to workplace, and from workplace to home😀😀🤔🤔, Chai 😂.
You go come still dey think of how you go take eat for even once in a day for 30 days before dem go pay you. 🙄 🙄
Una wey dey face this kind kasala, Una dey try ooo, I carry salute throw way for una 👮♀️👮♀️🙋♂️🙋♂️🙋♂️
Una wey dey put pressure on your applicants, make una fear God ooooo 🙄 🙄 🙄 🤔 🤔 🤔
The country people dey pass through kasala well! well.. No be small thing oo.
Agents, remember, your own no go ever pass you 🙏🙏❤️❤️
Applicants, Una wey dey think say una get wayo, and still wan do your agent shege, you no go ever get peace, because you no fulfill your promise ooo, God dey oo🙄🙄
Na the mudu wey you carry measure your agent, na that go still measure with oo😤😤🤣🤣
Shey, na you think say you servi wayo well! Well.🙄🙄🙄😝😝You go see shege 🙄 🙄
Shege and mungu go visit you 👺👹😈😈. If you like change, if you like no change, 🙄🙄🙄
That one too no go pass you ooh..
Abuja agents, Una wey dey do the right for your both applicant and client, make you continue with that, God no go shame una 🙏🙏🙏, and your own no go pass you.
Agents, some of you wey dey post fake job so that make you deceive your applicant to pay agent or registration fee, God go judge una all oo🤣🤣🤣, na still the same mudu go still measure una, that one too no go pass you 😀😀, Una go see shege 🙄 🙄, this one too