16/07/2026
Oga landlord wife don finally born albino Part 1
Na inside room I dey wey I dey hear everybody for compound dey shout, at d same time, dey thank God say, oga landlord don born pikin o.
E no reach 1 hour wey oga landlord carry pol!c£ come. Na so everybody con dey surprise, as dem see pol!c£ for Im back. Na Mr Christopher door dem waka go, go dey knock. As Mr Christopher come out, na so oga landlord tell d officer say, na im be dis. Na so d officer tell me Christopher say, dem wan see am for station.
As Mr Christopher see d officer, na so e begin cr¥, because, e dey fear pol!c£.
Na im oga landlord wife and im mama, with d new pikin for im back, enter compound. As oga landlord see dem, na para e dey para, dey tell im wife say, d pikin no be in pikin, say, na im papa be dis. Na so e point finger to Mr Christopher o. E say, im and Mr Christopher go go explain am for station, d person wey get d pikin, because, den no dey born albino for im family TO BE CONTINUED FROM PART 2