24/06/2026
Di Minister of di Federal Capital Territory (FCT), Nyesom Wike, say Nigerian no happy say di Super Eagles no dey play for di 2026 Fifa World Cup.
Wike, wey bin yarn dis one for di commissioning of di Gwagwalada-Kuje Road project on Wednesday, wia ex-Super Eagles captain, Joseph Yobo, attend, express sadness ova Nigeria failure to participate for di World Cup.
Di minister tell Yobo say despite Nigeria credentials and di number of players of Nigerian heritage featuring for di World Cup, Super Eagles no dey for di tournament.
“Yes, we don congratulate one of our stars, Joseph Yobo. But make I use dis medium through you to tell di Super Eagles: we no dey happy,” Wike tok.
E add: “If nobodi else go tell you that - becos I see pipo dey clap for you di moment dem see di Super Eagles - I say, ‘I no go clap.’ I no go clap becos I watch di World Cup. I see kontris wey I neva hear of bifor dey qualify to play World Cup, and I sit down for hours dey watch kontris wey no dey known.
“For dis contest, we get no less dan 13 top Nigerian players wey dey play all ova di world, but here we dey; we no qualify. Yobo, go tell dem. We no dey happy.”