23/07/2026
Na greed make this man cry like small pikin wey miss road or loss em mama money.
You do bricklayer work dem pay you 11,500.
You enter office make you see 2 odds play and your wish happen.. you com use 5k run am, luckily the game play you collect 10.6k... you come smile, com use the 10.6k play 3games wey comout 3.33 odds, luckily the game play, and you collect 40k+. Your guys dey hail you say na your day be this... Bro, you no fear u carry the 40k play 2 odds again, unfortunately, the game cut... Out of frustration, you use 3k from your initial money play again, the game cut... Na na only 3500 remain.... The person wey you dey owe con enter the place dey ask you for him money, u tell am make him hold on you go pay in few minutes time... Bro, you carry the remaining 3500 play 3.6 odds... You no dey fear oh!
Nice once...