Jar Abamwa

Jar Abamwa I love learning new ways to do things. I never say never!

04/06/2026

He's letting people know what’s really important 🥹

Friends.....how una take dey know who be really true friend? Na d way una dey groove together or na d way una spirit cli...
12/29/2025

Friends.....how una take dey know who be really true friend? Na d way una dey groove together or na d way una spirit click...based on the kind Spirit that worketh in u?

Na d way una views dey align or na d character of the person, be it good or bad, fiesty or calm, outspoken or quiet, extrovert or introvert....gossiper or non-gossiper...lol. Filled with the Holy Ghost, or what have you.

We know so no be everybody get friends...because of this or that reason.

Nowadays sef, people rather make friends via various social media platforms.

In those days when mobile phones never boku...people dey meet for neighboring streets, libraries and even birthday parties. But now, story don change.

Anyways, how una take dey know true friends?

Bible talk say dey is a friend that stick closer than a brother.

Who be that very good friend when u sabi?

Festive season dey come with some kind of pressure. Resarch say up to 1 in 6 papa and mama dey feel d heat because of th...
12/28/2025

Festive season dey come with some kind of pressure. Resarch say up to 1 in 6 papa and mama dey feel d heat because of the season. Funny enough d research say na mama dey feel am pass d papa.
The pressure na mostly money matter.....as dem feel say dey need to buy this and that to make their loved ones dey happy. Besides that, even if dem get certain amount of money for their bank account...dem believe say d money no reach to buy wetin dem envisage say their loved 1ces go really need. As e come be, people, and most especially parents dey stretch dem selfs so thin to please their children and loved 1ces, and in d process displease themselves.

No get me wrong oh. E dey lovely to exchange gifts with loved 1ces and observe heartwarming traditions. But e also dey important to do as u fit, because i believe say na d thought of love behind the gifts when matter pass the size or type or cost of d gift.
Abi wetin una think?

Address

Greenville, NC

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Jar Abamwa posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Shortcuts

Share